Federal Government Jails Another Igbo Man
Di Federal Capital Territory High Court for Gwarinpa Abuja don remand di former Minister of Labour and Employment, Chris Ngige for Kuje Prison sake of corruption accuse wey di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) sama on top im head. Ngige appear before Justice Maryam Hassan, dis Friday morning sake of eight-count charge of contract fraud as di EFCC tok say e bin dey use im position as minister, to dey award contracts to companies wia e get interest and to im associates too.